Search This Blog

Monday, March 25, 2013

Wife die under her neighbor wey dey grease her borris

This tori happen for Badagry wey one Housewife die when her neighbor dey help am grease her borris...The man wey him name na Lawrence Chukwuma enter wahala when he dey grease Mrs Lucy Joseph wey be 24 years old Borris... The matter wey happen fir Oke-Morosun Magbon for Badagry..We hear say the man wey be 48years old tell him wife say him dey work come later come ause when him wife and when the woman husband don commot..As we hear,dem say the woman and the man dey enjoy dem self when the woman start to dey breathe heavily before dem even carry am reach hospital na hin the woman don die... Dem neva know wetin fit cause the woman death ooo but dem don go drop the woman body for Badagry General Hospital say make doctors do Autopsy for am... the matter wey dem don report for Badagry Police Divison, wey be say dem don arrest Chukwuma wey be papa for 3children,dem don even transfer the matter go SCID for Panti for Yaba..After investigation the police come charge am go Ebute-meta Magistrate court say cos say na him cause Lucy death.. The court come talk say make dem leave am for prison until the report of the Autopsy go come out. Source:PM News/http://unilagolodo.com/2013/03/housewife-dies-during-sexual-intercourse-with-neighbour/

No comments:

Post a Comment