Search This Blog

Monday, May 20, 2013

accident for Sango Ota



One terrible accident happen yesterday around 5pm for Ijoju, Sango Ota, na two people dead.one trailer wey dem dey use carry sharp sand na hin crush one Okada man and his female passenger when they wan try cross the road. Their body wey dem leave there small before they come carry am...

Lagos people too dey drink


The Commissioner for Local Government and Chieftaincy Affairs, Mr. Ademorin Kuye na hin talk this thing yesterday. Make una read wetin him talk:
“Over N1billion is spent monthly in Lagos state on entertainment and parties, we have the records to confirm this and these people, how many of them pay tax? The money goes into drinks, wine,

food, aso-ebi and all of that and when they spend all of this money; they do not want to pay anything to the government”
“This justified the reason why local Governments demand that anyone organising events in the state must pay the Merriment Tax.”
“There is merriment tax in that constitution, its part of the rate Local Governments can collect. We have not fully utilised the benefit of the entertainment industry in this state”.

Star Boy win Artist of the year for Ghana

The tori wey dey reach US now be say the boi wey we know as StarBoy or as many people know Wizkid win another award again and this time no be for Nigeria here na for Ghana na hin the boi go win am come...

Thursday, April 18, 2013

indian man wey get money

this man buy cloth wey be say if u convert am to naira na 32million...my people no b small tin ooo

2chainz dey come naija

the tori wey we hear be say 2chainz that guy wey sing YUCK and CRACK dey come naija and no be say he just dey lasan ooo him dey come for Dbanj concept for june wey be say na the same day wey Dbanj dey do him birthday