Search This Blog

Friday, March 22, 2013

Relationship: Why women dey waka commot for Relationship

He don become general rule say when your girlfriend talk say she wan leave you,  say he mean say problems don dey. Chances dey say, you don do many things wey wrong and, he depend on how una matter be sha, but he fit come be say she dey leave you cos of wetin u no think about(o ma ga ooo). .
Here na some reasons why women dey always leave man:



1. Lack of attention:
Women dey love am when their men dey notice things about them and dey talk and listen to them. If una communication don get cough and she notice, she fit no dey satisfied with relationship again even if everything else dey go well. Abeg dey always Listen to am when she dey talk. If she feel say she no dey see love and attention from you, she go find wey go treat am right.

2. Lack of appreciation
Women do many things  than wetin men fit give dem, so appreciate the small things your baby dey for you. Make sure say u dey always hail am if she wear any cloth and dey tell am beautiful she be. make am know say u appreciate everything she dey do for you. 


3. Cheating
When you cheat, make u know say something don dey wrong for your relationship be that.  instead make u dey with the thing u decide say na to cheat na hin be the best way to solve am abi?. When dem come catch u the small bridge for trust don break be that. A relationship wey dey stable na TRUST dem build am on ooo, and if that don break, he no go dey easy to heal am. If una get wahala for una relationship,talk to your baby. After all,if na she do am,how u go feel?


Tomorrow we go continue!!! 

1 comment:

  1. Help us dey tell dem..wey their head no correct...

    ReplyDelete