one seven year old gal talk say her papa dey always rape am...The man wey be 49years old wey him name na Sylvester Ehijele don dey sleep with this small many times, wey be say na toys and goddies the make dey promise am before him sleep with the gal..
She say her papa dey always sleep with am everyday anytime her mama no dey...
She say anytime wey her mama no dey ause na so her papa go use power for am,use him hand take cover her mouth and put him rod inside am,she say as the man dey do am na hin he go dey promise am car and biscuit wey he no dey buy am..she come say he dey always tell am say if she tell her mama say him go use knife take commot her eyes...
The man wife wey her name be Magaret,talk say the man don rape their pikin wey be 23years old now when she dey small well well and he neva tey too the man don rape their one year old daughter
Magaret talk say she be caterer say one time for 2006 when she go work for Abuja wey she use 5days there,say her daugter wey be 16years old then call am around 1am say her papa just dey rape am finish now now wey she dey cry...she say when she reach ause wey she go meet her husband,she say the man beat am like say tommorow no dey, say anytime wey she go meet the man say na beating he dey beat am, say as she see say she no fit take am say how her husband go dey sleep with her pikin come dey sleep with am again na then she carry her load with her 6 children na hin dem leave the man ause for am...
She say for 2011,na hin Sylvester people come beg am say make she come back say cause of their pikin now, say her husband swear say he no go touch their daughters again wey she no get choice but to go back to her husband now..
She come talk say she dey very disappointed say he no neva reach one year wey she come back ause na hin her husband don go back to him stupid ways dem...
She say cos of their first daughter work dem decide to put her pikin wey be gal for day care for Ejigbo,she say na she be the only one wey dey always bring the pikin come ause everyday from that day care, but she say one day her husband go the Daycare,fight with the teacher,come carry the pikin go ause..
Say the baby come dey cry,say when she reach ause sef the baby still dey cry say she come dey wonder say wetin happen now say na then she come talk say maybe if she baff am say the baby go sleep now..say as she commot the baby pamapers like dis ehn,say na blood she see wey full the baby ?????,say as she see as her husband dey do now na hin make am go Ejigbo Police Station go report..
Magaret talk say she don dey marry this man for over 23years now...say she get 2 gals,4bois and one grand pikin, say wetin dey pain am be say dis man don sleep with him gals dem..
The Police P.R.o, Ngozi Braide talk say dem go soon carry sylvester go court for Defilement.
she talk say the man like to dey always sleep with him daughters dem and now na hin own grand daughter him sleep with say dem get report for hand wey show say dem dis gals ooo dem don rape dem..
she say the Vaginal Hymens of the gals no dey as person wey dem neva sleep with
sylvester come talk say him no do anything ooo say na him wife poison him pikin dem wey dem hate am like dat...he say him wife leave am say cos say him no gree to pay her dowry..ha!!!my people shey that one na talk??
No comments:
Post a Comment