Search This Blog

Tuesday, March 26, 2013

Na lie say dem find any headless body jawe

"Three headless bodies suspected to be that of females were thrown off a Range Rover Sport Jeep at Ijebu Ode-Ibadan Road just now.

"One is fair in complexion with University of Lagos identity card (Yetunde Ajao) inside her bag. The second is an Olabisi Onabanjo University student, Oyindamola Esan, also fair in complexion and tall.

"The last one is short, plump and dark with no identity. Please kindly notify their families and friends if you know them before the bodies are run over by vehicles."

Abeg my people dis story na lie jawe...the spokesperson for  Ogun State Police State Command Muyiwa Adejobi talk say the rumour na lie

him say:"When I heard about it, I alerted our men who went there but saw nothing and got no report of such thing in the area,"

we even hear say the people wey dey stay close to where dem talk say the body dey leave wetin dem dey do to go look if dem go see the body but dem no see anything..

One of the people wey dey stay there wey him name be Tolu Olaleye talk say people don dey come there as if say the place na tourist centre say cos say dem wan come see the body wey no get head now...

When dem visit UNILAG, dem search their database say dem no get anybody wey her name be Yetunde Ajao
Read wetin dem talk:"We also received the message about the headless bodies of three girls, one of which was believed to be a student of UNILAG. We checked all our digital records but the name Yetunde Ajao did not come up."


Source:PunchNG(http://punchng.mobi/output.php?link=http://www.punchng.com/metro/police-debunk-headless-bodies-broadcast/)

No comments:

Post a Comment