Search This Blog

Tuesday, March 19, 2013

lemme now..make una go catch all our senators....

one security wey dey work for Honda Company wey go meet armed robbers say make dem come rob him company of things wey worth N28m talk say make the police do am jeje as Mss Tonto take sing,say make dem police go catch our politicians wey dey thief our billions everyday... Garba Sanni, na hin be the security man name, him talk say the 12,000 wey him dey collect for salary too small say when dem come steal sef say dem no carry gun say na him even dey for duty,say him just call dem say make dem come ooo make dem carry the things wey dem carry so,one of the suspect(Godwin Okwudili) talk say make police drop the case oo as per say the things wey dem carry the police don see am(shey dem do like dat nii abi u are learner nii),him talk say na the same area him and sanni dey live,say na for night him see call from sanni say make dem come pack wetin dem come pack The Police Public Relations Officer, Ngozi Braide,say, “On June 31, 2012, about 9pm, four suspects connived with Sani, who is a security guard at Honda Place Company, Apapa-Oshodi Expressway, to rob the company of Honda auto spare parts worth over N23m, an air conditioner worth N77,500, a 150 KVA generator worth N3.8m, an 8KVA generator worth N900,000.“The total value of the goods is worth over N28m and after painstaking investigation, Sani was arrested. His confession led to the arrest of other suspects. The auto spare parts were recovered in Maya Village, Ikorodu, Lagos.

No comments:

Post a Comment