Abeg dis tori wey i wan sama una so he no good at all and he dey pain me gidigan and i wan ask una sef shey na by force say make u go serve when u neva finish nii?? when our own NSCDC for lagos be new trend for twitter and facebook,Na hin the NSCDC for Nasarawa don dey do their own work, the tori be say for National Youth Service Corps (NYSC) orientation camp for Tammah village, Nassarawa Local Government Area of Nassarawa State, na hin dem catch 62 fake corper oooo for monday... The fake corps members, wey be say na 44 females and 18 males, na hin dem arrest and person wey arrest dem na the state commandant, Mr Andekin Amos Musa, who talk say the routine surveillance of the command na hin make am possible for dem to take arrest dem...Him talk say “So far, our investigations reveal that one Chinedu is the coordinator and director of the fake camp. We also discovered that the fake corps members paid sums ranging from N120, 000 to N200, 000 before being admitted to the camp.my people una see wetin dey happen so...he never finish ooo him talk say when dem ask some of the people wey dem catch say dem talk say dem dey do evening classes for University of Jos,Jos, Plateau state..him come finalize am say make parents warn their pikin ooo or else...
Adebowale Ayeni..the onli perzin wey dey blog una confirm tori... To Contact Us: Call 08154905693 Or Add:269DEF17
Search This Blog
Wednesday, March 20, 2013
dem don catch 62 fake corpers for Nasarawa
Abeg dis tori wey i wan sama una so he no good at all and he dey pain me gidigan and i wan ask una sef shey na by force say make u go serve when u neva finish nii?? when our own NSCDC for lagos be new trend for twitter and facebook,Na hin the NSCDC for Nasarawa don dey do their own work, the tori be say for National Youth Service Corps (NYSC) orientation camp for Tammah village, Nassarawa Local Government Area of Nassarawa State, na hin dem catch 62 fake corper oooo for monday... The fake corps members, wey be say na 44 females and 18 males, na hin dem arrest and person wey arrest dem na the state commandant, Mr Andekin Amos Musa, who talk say the routine surveillance of the command na hin make am possible for dem to take arrest dem...Him talk say “So far, our investigations reveal that one Chinedu is the coordinator and director of the fake camp. We also discovered that the fake corps members paid sums ranging from N120, 000 to N200, 000 before being admitted to the camp.my people una see wetin dey happen so...he never finish ooo him talk say when dem ask some of the people wey dem catch say dem talk say dem dey do evening classes for University of Jos,Jos, Plateau state..him come finalize am say make parents warn their pikin ooo or else...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment