Search This Blog

Wednesday, March 20, 2013

2teacher die and many student don wound for Maiduguri

good morning my people...make una no vex say our news dey come late,we wan give una confirm story..as dey hear dis morning concerning the story of Maiduguri...dem say 3 schools for the capital of Borno state wey be Maiduguri say dem attack am on monday...wey be na 3 three teacher na hin die and wounjure 3 female students....them talk say this attack wey be say gunmen do am happen for early momo on monday wey come make all sculs for Maiduguri close down and parents dem come dey rush go pick their pikin dem for their sculs...Unconfirmed report talk say  three female teachers die for  Shehu Sanda Kyarimi Secondary School for Ruwan Zafi ward side....Vanguard gather say the attack happen for  9:10am on Monday around Ruwan Zafi area of Maiduguri, six suspected Boko Haram sect go hide for one corner of Shehu Sanda Kyarimi Secondary School, and shot teacher wey we never know the name,when  three female students carry injury from stray bullets..we also hear say around 11:20am for Mafoni area of Maiduguri, another gang wey we believe say dem be terrorists go attack Ali Askiri Primary School and shot one Mallam Abdullahi, before dem move go Mafoni Day Secondary School and kill a female teacher wey her name be as Hajja Yagumsu...When we contact on phone the spokesman of the Joint Task Force, “Operation Restore Order” Lt Col. Sagir Musa say him wan compile the details of the attacks and will respond officially as soon as he was done with the preliminary reports

No comments:

Post a Comment