Search This Blog

Monday, April 1, 2013

Dem catch 60n people wey dey steal oil


Our NSCDC people don start work now well well...dem catch 60m people for Majidun area for Ikorodu...As we take hear,we hear say dem catch this people wey dem dey steal fuel from pipeline for the place...we hear say this thing dey common for Majidun people wey be say people dem dis people dem specialize on Oil Bunkering...

On sunday night the NSCDC people go raid the place but dem no see anybody for the place na only kegs and pipe wey dem don spoil...but dis morning when the NSCDC people wey carry gun go there na him dem catch this 60people wey dem dey steal oil for the place wey be say dem see cutlass,gun and bottles for their hand

Obafaiye Shem wey be NSCDC spokesman talk say “At least, seven of my men are seriously injured by the villagers. They attacked our men with guns, cutlasses, broken bottles and other dangerous weapons

“Yesterday night, we got security tip that vandals were operating at Majidun area of Ikorodu, our men went there and saw several kegs of PMS and came with several of them. This morning, we got wind of vandals in the area again.

“We have to go back and the villagers came out to attack my men, but we succeeded in arresting 60 of them. We have received report that a baale in the area is behind the operation. My boys were attacked and wounded,”

One of the suspect wey him name be Adekoya Adebanjo talk say him no be bunker oo say him be merchanic,say him no attack any official ooo

Almost all the people wey dem catch dey talk say dem arrest dem wrongly

No comments:

Post a Comment