Search This Blog

Tuesday, April 2, 2013

2people na hin dem arrest for Ekiti

Police people for Ekiti don arrest 2people wey dem suspect say dem kill person...As we hear,dem talk say dem this 2 people dey involve for the killing of one Mr. Ayo Jeje wey be member of PDP...

The commissioner of Police for the state,Mr. Sotonye Wakama na hin talk am on monday...make una read wetin him talk:“We have arrested two persons. We went to Erijiyan and they pointed two men to us. They said that the two suspects were part of those who fired shots during the mayhem. Further investigation will show if they were culpable or not.”

Him come add say the whole place don dey in order after some omoita for the state disturb dem on saturday..

the man come later warn politicians say make dem stop all dis gobe and also make the police people too no go dey do magogo ooo...

As we take hear,we hear say wahala start on saturday when some omoita for the Erijiyan Ekiti go attack some people wey be ACN member before dem move go PDP

No comments:

Post a Comment