Search This Blog

Tuesday, March 19, 2013

We no like wetin him do....


our people wey dey obodo oyinbo wey be USA talk say dem no gbadun wetin our president Dr. Goodluck Jonathan do concerning the pardon wey him give former corrupt governor of Bayelsa State, Diepreye Solomon Peter (DSP) Alamieyeseigha.say make former head of state Gen. Mugamadu Buhari and other state Governors say make dem come out come talk which side dem dey so people for Nigeria go know.....former Provost Marshal of the Nigerian Army, now a chieftain of the Peoples Democratic Party (PDP) in Edo State, Brig.-Gen. Don Idada Ikponmwen, come talk say everything wey dey happen for our country say na corruption dey cause am ...the Executive Director of the National Democratic Liberty Forum (NDLF), Mr. Bokola Oreofe,talk say make President Obama tell Goodluck make him reverse the pardon...abi my people wetin be the meaning of wetin our president sef dey do?/ Why u go give person wey go keep money for him state for him pocket pardon? he dey baffle me ooo....God dey Watch Una sha in 3D

No comments:

Post a Comment