Search This Blog

Thursday, March 21, 2013

GTBank Driver steal N17.3m


One GTBank Driver wey him name be Olusegun Fatokun na hin dem don take go court...This person wey dey stay for No. 4, Wemimo St., Bariga, Lagos, appeared for one-count charge of stealing....The Prosecutor,Sunday Ibrahim say the accused steal 100, 000 US dollar and 10, 000 Euro, which if u take go meetv aboki na  N17.3 million wey be bank own....Ibrahim talk say Segun leave the money for the back of the van he him go offload, adding say he(segun) later take the money and hide am for him friend house. He talk say dis tin happen for March 8 at 6.30 p.m for GT Bank,wey dey Adeyemo Alakija Branch, Victoria Island, Lagos....However, Segun talk say him  no dey guilty of the charge.
The chief magistrate, Mrs A. Demi-Ajayi grant am bail in the sum of N500, 000, with two sureties in like sum.
Source:Osundefender.org

No comments:

Post a Comment