Search This Blog

Wednesday, March 20, 2013

one pregnant woman and one hotel manager die after kidnap

good evening my people, the tori wey just dey touch me na the tori of one pregnant woman and Hotel manager wey die...the man na the manager of Naija Plaza Hotel for Oguta for Imo state and one pregnant woman.. this bad belle people Kidnap the 2 of them and collect money from the family of these 2 people before they come kill dem...the suspect one Mr. Richard Chika Nwabiarijie who come from Omoku Local Government For Rivers State na hin dem arrest for Ojo area with him wife...this Richard wey be run leave Rivers State come Lagos when dem arrest him gang member by the police people of imo state....As the thing take happen be say this bad belle people wey be six in number dress as military people come enter the Naija Plaza Hotel on 24 February 2013,where dem kill 2 police wey dey secure the hotel when dem come kidnap one Mr Emeka Asema wey be Charlie boi cousin...but unfortunately na the lifeless body of this charlie boi cousin na hin dem find...before dem carry this Mr. Richard go for Police motor,him talk say him no get anything to do with Emeka kidnap ooooo..na wetin him talk be " I fled from Rivers to Lagos, to hide  when I heard that members of my gang had been arrested. I swear to God, I was never involved in the kidnap of the hotel Managing Director. My colleagues did. They went to the hotel at about 8.30 pm and abducted him. In the process, they killed two mobile policemen on guard and made away with their riffles. The manager was brought to our hide out in Rivers state where he was held hostage for some days before the sum of N2.1 million  was received from his relatives as ransom.

On the day he was to be released, they blind- folded and drove him  out of the compound. But midway into the journey to his home town, they killed  him and dumped his body on the road.

 Our modus Oparandi

We don’t just abduct anybody any how. We must have gathered information on the person’s financial background before we strike. We operated mostly in Imo state and our informant there is one Udo. Whenever he got information on anyone, he would alert us. I would then come from Rivers state and together  with other members, we would be monitoring our target’s movement and  security around the area before going into action.

Sometimes, we used  motorbikes or cars and at other times we use both. We would intercept the victim with the motorbikes or car and thereafter, order him/her to come out of the car.  If we were operating on motorbikes, we would zoom off in the victim’s car  and head straight for my place in Rivers,where the victim would be kept  until ransom was paid.”

him talk say na  N500,000 for every opeartion wey him do.. when dem ask how him take join the gang him talk say na Uche and Udo wey police still dey look for say na them introduce am to the business, say na for one Bar na hin him for meet them say cos say him no get job now say na why devil push am make him join am...him come talk say since when him don join the gang, na only 3 operation him don do with them say after the operation na N300,000 be him own share...him come talk say dem kill one woman wey get belle after dem collect money from the woman people, say when him come ask dem say why dem dey kill all this people say dem talk say na bcos dem no wan make them go tell police who dem be since wey be na the same state dem dey now..but wetin come sweet me pass be say him talk say him dey ready to take police go where dem dey manufacture their own guns for Rivers State,say him own work na to follow dem go kidnap and watch over the people wey dem kidnap..when we ask how dem take catch am,dem say Imo police people start their work when dem find the body of the Hotel  Manager wey be Charlie boi Cousin,say na then dem catch their gang leader wey be okorie..when dem ask Okorie wey be 35years old who come from Amii Igbere For Bende Local Government for Abia State but him dey stay for Adimma House Ibochqa Egbema...make una read wetin Imo State Police Oga t Musa Katsina talk" was discovered to have sneaked into  Oguta where his girlfriend,one Ifeoma, harboured him for  three days before the abduction of the hotelier.

Okorie’s confessional statement reportedly led to the arrest of four other members whose identities were given as Onyemuche Chris Ordukwu, a  26 -year-old barber  from Obakata Quarters in  Omoku Rivers State; Nze Damian Onyenye, 26 -year- old graduate from  the Institute of Management and Technology, IMT;  29-year-old  Ifeoma Ukachukwu, a  native of Oguma Oguta and 50-year-old  Ikechukwu Ossai who  hails from Oguta as well." ..the Police people for Imo State talk say na dem alert Police for Ilemba Hausa say Richards don dey wey dem go pick him and him iyawo on monday...Police don carry go station for investigation and prosecution....Make una help me give our Police 3 gbosa for their work jawe...
Source:http://www.codewit.com/nigeria-news/6424-nigeria-a-pregnant-woman-and-hotel-md-killed-after-kidnapped

No comments:

Post a Comment