Dem throw Ejike Igewkile for 2 storey building for Rev. Adegoke Street for Canal Estate For Okota for Lagos by him In-law wey dey vex..
As i hear dem talk say wetin Ejike do be say him beat him wife Nkiru wey be 27years old wey make am run commot for ause with her daughter to her parent ause for 4,Iworo street Orile Coker wey be say he neva reach 1year wey dem marry..
Igwekile wey come form Okija for Anambra State talk say dis year when him and him wife get small quarrel na hin him wife carry carry him pikin commot for ause when him don go work..
him talk say when the pikin come sick,the wife come dey call say make him bring money wey she go use take carry the pikin go hospital,but him ignore dem say na until she come ause with him pikin na hin him go fit drop money..
When him no answer dem na hin,him wife mother Patricia Philip come him ause come pak him wife load say dem no dey marry again..say na when him talk say lailai she no fit pak the load na hin she call her son wey him name na Charles,say Charles come come with another 2 people wey be say dem beat and well well before dem throwa from the ause...him break him head and leg wey be say he no fit waka well well again...
Dem don arrest Patricia sha but her son Charles and him friends don disappera..
Patricia talk say na lie,say na when dem start to dey beat am na hin him jump from the ause ooo
But dem don charge Patricia go court sha

No comments:
Post a Comment