Search This Blog

Thursday, March 21, 2013

Boko Haram no be Ghost-Asiwaju Bola Ahmed Tinubu

On Thursday na him the former Governor of Lagos State wey him name be Asiwaju Bola Ahmed Tinubu talk say him know say the Boko Haram people no ghost say dem be human being wey dey chop rice and drink dey drink fanta...Tinubu, wey be the National Leader of Action Congress of Nigeria, wey go Kano to commiserate with the Emir of Kano, Alhaji Ado Bayero, for the attack on am and him convoy recently, talk say the amnesty wey dem wan give the Boko Haram must base on justice, particularly for those wey no get blood stain for their hand(shey any boko haram dey wey blood no dey him hand?) him come talk say anyone of dem wey dem catch wey must to dance to the azonto of the Law..him come talk him no gree with Mr. President say say those people na ghost..for the Emir palace,him talk say him no gbadun wetin those bad people do for the baba palace...The Emir, thank Tinubu for him visit, say him be a visionary and purposeful leader for every aspect of life by showing good example to the ordinary people.

No comments:

Post a Comment